Trump tariff pause: US increase China levies to 125% - BBC News Pidgin (2025)

Trump tariff pause: US increase China levies to 125% - BBC News Pidgin (1)

Wia dis foto come from, Getty Images

US President Donald Trump don announces a 90-day pause on higher tariffs for dozens of kontris, but increase levies on China to 125%.

Dis dey come afta China bin announce 84% tariff on US imports sake of say Donald Trump impose 104% tariff on Chinese goods wey dey enta di US.

Earlier dis month, di US president bin announce a "baseline" tariff of 10% on all kontris, wit higher rates for di "worst offenders"

But e don tok say di higher rates go dey paused for 90 days, and instead di "reciprocal tariff" go be 10%

Trump say di rate for China go rise to 125%, becos of "di lack of respect wey China don show to di world markets".

  • African export products wey Trump new US tariffs hit well

  • South Africa President Ramaphosa call for negotiation after US 30% tariff hit

  • List of countries Trump reciprocal tariffs affect for Africa and around di world

Wetin Donald Trump tok

Trump tariff pause: US increase China levies to 125% - BBC News Pidgin (2)

Wia dis foto come from, Getty Images

China announce 84% tariff on US goods

Trump tariff pause: US increase China levies to 125% - BBC News Pidgin (3)

Wia dis foto come from, Getty Images

Bifor di new 125% tariff wey Donald Trump impose on China, di Asian kontri bin increase dia retaliatory tariffs on US imports to 84% afta di American president sama dem wit 104% levy earlier.

Dis come afta China foreign ministry insist say di kontri go "fight to di end" against Trump tariffs, and accuse di White House of "bullying practices".

For im first comment since China announcement, Trump tell businesses now na di "great time" to move to di US

Meanwhile, di European Union dey prepare di range of counter-tariffs, including 25% tax on US products such as motorbikes, luxury boats and orange juice

Dis come as stocks for European drug makers slip afta Trump tariff drop on all pharmaceutical imports

Bifor steeper tariffs on around 60 nations come into effect today, Trump tok say many kontri dey "die" to negotiate deals. "I dey tell you dis kontri dey call us up, kissing my ass," e tok.

Di Bank of England tok say Britain dey well placed to stand di situation but warn of future risk as di UK goment say e dey "confident" e go get US trade deal.

How we take reach dia

  • 20 January: Trump use im inauguration speech to outline plans to override di trade system "to protect American workers" and introduce tariffs on foreign kontris "to enrich our citizens"
  • 1 February: E announce a 25% levy on Canadian and Mexican imports to di US - and an additional 10% on China
  • 3 February: Mexico and Canada reach a deal to pause US tariffs for one month
  • 10 February: Trump announce a 25% import tax on all steel and aluminium wey dey enta di US
  • 4 March: Di White House place an additional tariff on Chinese imports
  • 12 March: Trump 25% steel and aluminium tariffs take effect
  • 26 March: Di White House reveal new 25% duties on car and car parts wey dey come into di US - e take effect from 2 April
  • 2 April: Trump announce dat di US go impose "reciprocal tariffs" on certain kontris, as well as a universal 10% levy on imports from all oda kontris
  • 5 April: Di 10% "baseline" tariff come into effect
  • 9 April: Custom tariffs on roughly 60 kontris - on di worst offenders - come into effect

Canada hit back at US car tariffs wit 25% tariff

Canada tok say dem don impose 25% tariff on certain vehicle imports from di US, retaliating against similar measure from dia neighbour.

Di tariffs - or import taxes - na Canadians wey buy some automobiles or dia parts from di US go pay am.

Canadian Finance Minister Francois-Philippe Champagne confam say im kontri dey respond to "unwarranted and unreasonable" tariffs, e confam say di new taxes go apply afta midnight on Wednesday.

US President Donald Trump don issue tariff wey go apply globally and specifically aim at some of im top trading partners, including Canada. E claim say dem go address unfairness in global trade.

Canada no dey directly hit by di new American tariffs but Ottawa don already dey for Washington ova Trump pre-existing policies.

"We go protect our workers, our businesses, and our economy," Champagne write on X, as im confam di start of di retaliatory Canadian measures.

Di Canadian car tariffs come afta Trump import taxes of 25% on cars entering di US come into effect. Taxes on car parts dey set to start next month.

Dis move dey particularly painful for Canada, wey car industry dey entwined wit US.

Along wit China and Mexico, Canada don already catch up wit Trump tariffs, wey dey design to pressurise dis kontri to stem di flow of illegal migrants and drugs into di US.

Wetin bin emerge na blanket tax of 25% wey American importers dey pay for all goods from Canada - except dose wey dey under di existing North American free trade agreement, and wit lower rates for energy, potash, aluminium and steel.

Trump tariff pause: US increase China levies to 125%  - BBC News Pidgin (2025)
Top Articles
Latest Posts
Recommended Articles
Article information

Author: Amb. Frankie Simonis

Last Updated:

Views: 5451

Rating: 4.6 / 5 (56 voted)

Reviews: 95% of readers found this page helpful

Author information

Name: Amb. Frankie Simonis

Birthday: 1998-02-19

Address: 64841 Delmar Isle, North Wiley, OR 74073

Phone: +17844167847676

Job: Forward IT Agent

Hobby: LARPing, Kitesurfing, Sewing, Digital arts, Sand art, Gardening, Dance

Introduction: My name is Amb. Frankie Simonis, I am a hilarious, enchanting, energetic, cooperative, innocent, cute, joyous person who loves writing and wants to share my knowledge and understanding with you.